Our Naija super strika, Victor Osimhen, don show for Napoli.
![]() |
Naija and Napoli strika, Victor Osimhen |
Una sabi say Osimhen bin get injury wey make am no play for Napoli – di tin holam so tey e no fit play for first leg against AC Milan.
Cos say Osimhen no play for Napoli, nobodi fit score for dem wen dem fes nack against AC Milan for San Siro Stadium – las las, nah AC Milan take 1-0 win di game.
Buh di beta tori wey dey gran bi say our bobo don show nah – e don fit, cos say e enta for Napoli for the las game wey dem nack witi Hellas Verona, nobodi score for di game shaa.
We neva sure say Osimhen go play abi e no go play for Napoli today, Tuesday 18 April, 2023, against AC Milan wen dem go jam for UEFA champions league second leg.
I jus dey feel say Osimhen fit nack for Napoli today cos of dis Foto wey dem UCL drop.
Abeg, make we see Osimhen as e pose witi our Naija flag ⬇️
Foto: I dey hala @ChampionsLeague