Ogbonge Naija Afrobeats singer, wey dem dey call, David Adedeji Adeleke, buh person fit call am, Davido, cos na im stage name be dat, don come out tuk say, our election for Naija “nah by who rugged pass”.
![]() |
Presido Asiwaju Bola Ahmed Tinubu |
Dis one wey Davido tuk nah after dem finish matter for inside Presidential Election Petition Tribunal (PEPT) for Court of Appeal, Abuja, Nigeria on Wednesday 6 September, 2023.
Presidential Election Petition Tribunal (PEPT) tuk say Tinubu win di election, say im victory nah ogbonge, Court even tuk join say, all di petitions wey Labour Party (LP) witi People’s Democratic Party (PDP) drop against Tinubu no solid at all.
Even di 25% FCT votes wey Presidential candidate suppose win for Presidential Election, Court tuk say e no dey compulsory, dem come tuk join say, FCT people no dey special.
Nawa o, dis one shock me o! Just like dat, wetin come do our Naija constitution cos I believe say 25% votes for FCT dey compulsory…based on wetin Naija constitution tuk.
Davido tuk say: “Nigeria Election nah by who rugged pass.”
Buh me no agree witi Davido at all cos e suppose by our Naija constitution no be “by who rugged pass”.