Hmm…our Naija Presido Buhari wear Army General uniform.
![]() |
Naija Presido Buhari for inside Army General uniform |
As we sabi say Bubu dey like wear native like all dis agbada…like dat-like dat shaa.
Buh im jus wear Army General uniform cos say e follow do one kain event wey Naija Army dem dey do once-once wey dem dey call ‘Nigerian Army Trooping and Presentation of Colors’ Parade 2023’.
Di event nah for inside Eagle Square for inside Abuja dem do am.
As una sabi, Bubu nah GCFR wey be ‘Grand Commander of the Order of the Federal Republic’, so e gats to wear Army General uniform for di event.
Make I no lie, the uniform dey alrite for Bubu body.
Abeg, make we see our Naija Presido Buhari for inside Army General uniform ⬇️
Foto: I dey hala @BashirAhmaad