Presido Buhari inside Army General uniform

Hmm…our Naija Presido Buhari wear Army General uniform.

Naija Presido Buhari for inside Army General uniform
Naija Presido Buhari for inside Army General uniform

As we sabi say Bubu dey like wear native like all dis agbada…like dat-like dat shaa.

Buh im jus wear Army General uniform cos say e follow do one kain event wey Naija Army dem dey do once-once wey dem dey call ‘Nigerian Army Trooping and Presentation of Colors’ Parade 2023’.

Di event nah for inside Eagle Square for inside Abuja dem do am.

As una sabi, Bubu nah GCFR wey be ‘Grand Commander of the Order of the Federal Republic’, so e gats to wear Army General uniform for di event.

Make I no lie, the uniform dey alrite for Bubu body.

Abeg, make we see our Naija Presido Buhari for inside Army General uniform ⬇️

Presido Buhari inside Army General uniform

Foto: I dey hala @BashirAhmaad

SHARE ARTICLE:

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

DISCLAIMER: Comments and opinions on HenrisCounty are solely those of the Original/Anonymous Authors. These comments and opinions do not represent those of HenrisCounty. HenrisCounty reserves the right to remove offensive comments, links or images.