Napoli don win Scudetto: See as fans love Osimhen, tuk say ‘God is the greatest’

Nah dis kain tin I dey call “beautiful”.

Our Naija ogbonge striker wey dem dey call Victor Osimhen don carry Scudetto “deliver” give dem “Napolitans”.

See as Napolitans gather dey show plenti love for our Naija ogbonge striker, Victor Osimhen afta e don "deliver" Scudetto give dem
See as Napolitans gather dey show plenti love for our Naija ogbonge striker, Victor Osimhen afta e don “deliver” Scudetto give dem

Osimhen wey dey nack ball for Napoli don come out tuk for oyibo say, “GOD is the greatest”, e come tuk join, say “A prophesy fulfilled”.

Di Serie A match wey Napoli play for Udinese, e finish 1-1 and di two teams com share one-one point – nah dat one point Napoli need to take carry Scudetto and nah Osimhen score di goal wey make Napoli take collect dat one point.

As di match finish, na so dem carry Scudetto arrange give Osimhen and im Napoli club.

E don tey well-well wen Napoli carry Scudetto last, e don even pass 30 years.

Osimhen jus carry Scudetto “deliver” give “Napolitans”, e tuk for oyibo say: “Dear Napolitans, The Scudetto Has Been Delivered!!! Now We Feast!!!!


“A Prophecy Fulfilled! GOD Is The Greatest.”

Infat, make we salute our Naija ogbonge striker, Victor Osimhen, no be only say e “deliver” Scudetto give “Napolitans”, buh say na im be number one for goal, e don score 22, no oda player near am.

For dis foto, see as fans jus love Osimhen plenti plenti.

Chai…dis love too much o!

Abeg, make we see Osimhen witi Napolitans as dem gather am ⬇️

See as Napolitans gather dey show plenti love for our Naija ogbonge striker, Victor Osimhen afta e don "deliver" Scudetto give dem

Foto: I dey hala @victorosimhen9

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *