I don tuk am before say money good well-well.
![]() |
Oga Femi Otedola dey gbadun beta evening witi Ogbonge Naija Afrobeats singer, Ayodeji Ibrahim Balogun AKA Wizkid for im house for London inside obodo England |
Ogbonge oga wey dem dey call, Femi Otedola, don gbadun witi our Naija Afrobeats singer wey dem dey call, Ayodeji Ibrahim Balogun AKA Wizkid, for im fine house for inside London for obodo England.
For una wey neva sabi, Femi Otedola, na im be oga patapata for Geregu Power PLC, e com out tuk for oyibo say, “Lovely evening with @wizkidayo at my London residence”.
Nah today wey be Saturday 1 July, 2023 dis one hapun o!
Oya nah, make we see Wizzy outift plus Oga Otedola own too. Di two of Dem jus dey simple and e make sense like dat.
Foto: I dey hala @realFemiOtedola