Naija electoral body, wey be INEC, don come out dey beg “people of Edo State, make una come out in large numbers, cast una vote for di person wey una believe say e go do well for una.”
![]() |
Nah di sensitive materials wey dem go use run di Edo State Governorship Election 2024 land so for Benin Airport, Edo State |
Di Commission come still dey beg say, “make una no sit down for house on 21st September 2024.”
As una know say di Edo State Governorship Election 2024 go shele for Saturday 21 September, 2024 – abeg, make una no dull o.
INEC tuk say: “Great people of Edo State, make una no sit down for house on 21st September 2024.
Dis election na di time to show say una voice matter well well.
Make una come out in large numbers, cast una vote for di person wey una believe say e go do well for una.
Make una no fear,
Una vote go count…
Di future of Edo State dey for una hand.
#EdoDecides2024 “
HC: Na so o! Edo people make una shine una eye cast una vote for person wey una “believe say e go do well for una”. Una vote go surely count!!
Foto: Salute to @inecnigeria