AC Milan players no dey happy as dem chop better 0-2 humiliation for inside dem house, San Siro, for di hand of Ferencvaros for di League Phase game for Uefa Europa League 2026/27 wey dem play for Thursday 5 November, 2026
AC Milan players no dey happy as dem chop better 0-2 humiliation for inside dem house, San Siro, for di hand of Ferencvaros for di League Phase game for Uefa Europa League 2026/27 wey dem play for Thursday 5 November, 2026

Ferencvaros yeye AC Milan 2-0 for Europa League game for San Siro

Ferencvaros, wey dey play for NB 1 for Hungary, travel go for inside Milan City come yeye ogbonge club, AC Milan, wey dey play Serie A for Italy, 2-0, for di Uefa Europa League 2026/27 League Phase game wey dem play for Thursday 5 November, 2026 for inside San Siro.

Di result for di game don show say futbol no dey easy again. Anoda tin be say, Ferencvaros don dey play European futbol e don tey now, pass sixty (60) years, so dem no be baby for Europe, buh, AC Milan suppose use home advantage at least take finish draw.

Plus AC Milan, wey dem nickname Rossoneri, enter di game against dis Hungary Club after dem don beat dem neighbour Inter 3-1 for dem Serie A League game wey dem play for di week wey pass. At least, dis outcome against Nerazzurri suppose boost deir morale for Thursday game.

Anoda tin wey come dey shocking be say, Ferencvaros even later come dey play witi ten (10) players after one Naija winger, wey be Bamidele Isa Yusuf, collect straight red card for seventy-seven (77) minutes, and upon dat, the side wey dey home no fit even score one, hmm…nawa o!!

Referee send Yusuf comot after technology, wey be Video Assistant Referee (VAR), don review di foul come judge say di Naija player drop elbow give Mario Gila for face.

So, as di game start, di two (2) side play so tey dem no see goal score for inside di first forty-five (45) minutes, buh, nah Ferencvaros come later score two (2) times for di second half through Lenny Joseph, wey be Haiti national team forward.

Joseph score di first goal for Ferencvaros for 52 minutes witi assist wey Kristoffer Zachariassen give am, and before AC Milan know wetin dey happen, dem Hungary visitors don score anoda goal, dis time nah for 66 minutes, and nah di same Joseph do am, witi di same Zachariassen wey assist am.

Before Ferencvaros start to yeye AC Milan, di Rossoneri try make dem score, buh, Gonçalo Ramos fire one ball down for inside dem opponent penalty area, buh Alphadjo Cissè come blast im shot go over.

After Joseph don finish to dey yeye dem hosts, nah dat time AC Milan come wake up, buh, all dem effort no bring dem any good result. Omari Hutchinson, wey be English attacking midfielder, hustle enter inside di left side of Ferenvaros box, buh, im shot jus go wide.

Di result mean say Ferencvaros never taste defeat for dis Europa League 2026/27 as dem play four (4) games and win all di four (4), and all di point wey dem don accumulate com be twelve (12).

Buh, AC Milan com dey for tight corner where be say dem dey for 28th spot and nah only three (3) points dem don gather since dem kick off dem Europa League campaign. Di Rossoneri don play four (4) games, dem win one (1), den lose three (3).

Resuts

SHARE ARTICLE:

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

DISCLAIMER: Comments and opinions on HenrisCounty are solely those of the Original/Anonymous Authors. These comments and opinions do not represent those of HenrisCounty. HenrisCounty reserves the right to remove offensive comments, links or images.