AFCON 2025 Qualification: Libya V Nigeria – ‘My body still dey shake’ – Nah Boniface tuk am

Naija sharpshooter wey be Victor Boniface, don tuk say, im “body still dey shake”.

Super Eagles of Naija confam striker, Victor Boniface, as e sit down for airport for inside obodo Libya. Dem jus abandon Naija players witi officials...
Super Eagles of Naija confam striker, Victor Boniface, as e sit down for airport for inside obodo Libya. Dem jus abandon Naija players witi officials…

Dis one wey Boniface tuk nah after di suffer-suffer wey dem suffer for di airport for inside obodo Libya.

As Super Eagles dem reach Libya for di AFCON 2025 qualifier wey dem won follow Libya play, na so di airport officials no gree answer dem, come leave dem for dere “no food no wifi”, as Ogbonge striker, Boniface, tuk.

CAF don come out tuk say di AFCON 2025 qualifier wey suppose shele between Libya and Naija for Tuesday 15 October , 2024 no go shele again cos say di tin wey dem Libya do Naija players witi officials no good at all.

Dem even tuk say dem go look into di matter make dem know why and wetin cause am, and dem go come decide who dey at fault and land am better sanction.

Dis tin wey Libya do Naija nah wetin Super Eagles skippo, William Troost-Ekong, tuk for oyibo say nah “disgraceful behaviour”, and cos of dat “we will not play this again”.

Upon say di tin don happen pass, Naija witi Bayer Leverkusen striker, Boniface, tuk say, “my body still dey shake”.

Wetin dis mean be say, no be small humiliation Libya dem give our Super Eagles witi officials.

HC: CAF we dey wait o!…Hmm!!

Super Eagles of Naija confam striker, Victor Boniface, as e sit down for airport for inside obodo Libya. Dem jus abandon Naija players witi officials...
Super Eagles of Naija confam striker, Victor Boniface, as e sit down for airport for inside obodo Libya. Dem jus abandon Naija players witi officials...

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *