Super Eagles semi final clash against Morocco ‘no go easy sha o’ – Asisat Oshoala

Super Eagles semi final clash against Morocco ‘no go easy sha o’ – Asisat Oshoala

Ogbonge Super Falcons striker, Asisat Oshoala, don chook mouth for the semi final game wey the Super Eagles go follow Morocco knack for Wednesday.

Oshoala, wey dey play for Saudi Women’s Premier League club, Al Hilal, tuk say, di showdown “no go dey easy sha o” cos of wetin Naija Super Falcons do Morocco Women’s team for the Women’s Africa Cup Of Nations (WAFCON) 2025 wey Naija beat Morocco 3-2 for di final.

Super Falcons win dem 10th WAFCON title after dem come from two (2) goals down beat Morocco for inside the Olympic Stadium wey dey for Rabat for July 26, 2025.

Oshoala, wey don win African Wome’s Footballer Of The Year, for six (6) good times (2014, 2016, 2017, 2019, 2022, 2023), tuk say, even the referee wey officiate that WAFCON final game, dem Morocco carry am go court.

After Naija hammer Algeria 2-0 for Marrakesh Stadium for Saturday evening, dem go now jam head witi Morocco, wey dey host AFCON 2025, for inside the Stadium wey dey for Rabat; the game go shele on Wednesday 14 January, 2026 for 21:00 (WAT).

Asisat Oshoala tuk for X say: “That semi final no go easy sha o cus that WAFCON still Dey pain Morocco. Them go do everything and anything but the world will be watching. People wey carry referee wey officiate our final go court”

Oshoala start her futubol career for River Angels, wey dey for Port Harcourt, Rivers State, before she come move go Europe – play for big-big clubs, Arsenal Liverpool, Barcelona, before she come join Al Hilal for Saudi.

She don win WAFCON four (4) times (2014, 2016, 2018, 2024), and she be one of di African female footballers wey dem dey celebrate pass as say she don win plenty-plenty titles plus individual awards.

Foto: Asisat Oshoala, dat time wen she still dey play for Spanish club, Barcelona Women’s Team | Getty Images

SHARE ARTICLE:

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *