‘Dem dey quick carry my picture anytime I talk about Peter Obi or wetin concern the country’ – Charly Boy

Oga kpatakpata wey dey run OUR MUMU DON DO Organization wey be Charly Boy, don come out tuk say, “dem dey quick carry my picture anytime I open mouth for this online street, especially when I talk about Peter Obi or wetin concern the country.”

Charly Boy
Charly Boy

Area Fada tuk say, “dem forget say I be entertainer, na my work to express myself”, come tuk join say, “If your hand clean, abeg cast the first stone. If you holy pass, make we see your own picture make we measure am”.

As Charly Boy take tuk am: “Dem dey quick carry my picture anytime I open mouth for this online street, especially when I talk about Peter Obi or wetin concern the country. 


Dem go flash this same image like say na my full life history dey there. Dem forget say I be entertainer, na my work to express myself, but some of una dey judge me like say I owe anybody perfection. 


But make I ask una, how many of una wey dey drag this picture don ever try read wetin dey my inside? Abi na only the cover una sabi look? E easy to point finger, but truth be say, nobody holy pass. 


If your hand clean, abeg cast the first stone. If you holy pass, make we see your own picture make we measure am. But I dey laugh, because na so life be—people go always point finger when dem no even fit sweep their own backyard. 


I no send anybody. My message na my message, no be my face go carry am. If the truth dey pain you, na you sabi. As for me, I go continue to dey talk my talk. Whether you like am or not, my life no dey for una hand.”

Charly Boy
Charly Boy

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *