Naija musician, Peter Okoye, AKA, Mr P, wey dey for the Group, P-Square, before before, tuk say e dey tink am weda e go relocate go Dubai.
Di ‘Winning’ crooner tuk say, Dubai no get wahala at all. E say the kontiri get peace well-well, say, nothing like “gun violence, no insecurity, and no fighting”.
Mr P tuk say for oyibo, “the transformation that has taken place in Dubai over four years plus is remarkable.”
Di ‘I No Like Trouble’ singer tuk say, e dey reason am say, e go turn Atlanta to im third home, the, Dubai go be im second.
Di former member for P-Square Group tuk say Dubai dey ok to raise Pikin.
Mr P tuk say: “I have not visited Dubai in over four years plus, and the transformation that has taken place is remarkable. Everywhere is so peaceful. As I dey reason am, e bi like say that Atlanta go turn my 3rd home then Dubai go bi 2nd!
“how una see am? I wan check something.
“Dubai is a peaceful place to raise your kids; there is no gun violence, no insecurity, and no fighting, etc. Omo person no go relocate so?”


Reply wey dem drop give Mr P
@LawrenceBamid13 wrote: “Hmmmm, First thing that disturb our entire country is insecurities, how on earth that we won’t be able to sleep at night…. My thoughts with benue states and others.”
@derektitus007 wrote: “Then need get that street OT so try dey bring them home once in a while.”