Charly Boy, oga kpatakpata wey dey run OUR MUMU DON DO Organization, don come out dey hail Davido after di singer tuk say, Naija economy dey in “shambles”.
![]() |
Charly Boy |
Area Fada tuk say, “Pls make una leave Davido alone, e talk am as e see am.”
As e be, e get some pipu wey no like wetin Davido tuk about Naija economy for di interview, like Bashir Ahmad witi Reno Omokri.
Bashir Ahmad tuk say, “Davido should know selling out your country from foreign soil is unpatriotic”.
Reno Omokri tuk say, “Davido should learn from Rihanna, who never talks down on her country and instead uses her celebrity to promote Barbados”.
As Charly Boy take tuk am: “Many Nigerians are living in denial. They hate the Truth but Thank God the truth don’t care.
Pls make una leave Davido alone, e talk am as e see am.
Well done bro.
Pepper dem more.”