Naija Super Eagles winger wey be Moses Simon, don tuk say im “won go home ooo” com tuk join say, “I no play again ooo abeg”.
![]() |
See as Libyan gonment jus abandon Naija players for airport for inside Libya. Chai! dis one no good cha-cha |
Dis one dey shele as Naija players dey for Libya airport wey dem Libya gonment no gree do dem well, come even leave dem for di airport pass “13 hours, no food no wifi”, as ogbonge striker, Victor Boniface tuk.
Super Eagles skippo wey be William Troost-Ekong, come vex tuk say Naija no go play di game again for inside Libya, say Libyan gonment do “disgraceful behaviour”.
Moses Simon tuk say: “Me I want to go home ooo I know play again ooo abeg.”
Skippo, Troost-Ekong, don later tuk say, dem don dey put fuel inside plane, say players witi officials go soon land enter Naija.
HC: Nawa o! CAF suppose do sometin for dis matter o!
Foto: I salute NIDCOM (@nidcom_gov)