Naija Afrobeats singer wey be David Adedeji Adeleke OON, buh im stage name nah Davido, don come out announce say, e go do one big show wey e call ‘A.W.A.Y Festival’ for Atlanta wey dey inside obodo America.
![]() |
Naija Afrobeats singer, David Adedeji Adeleke, wey im stage name nah Davido, for BET Awards 2023 |
Di event go happen for State Farm Arena, Atlanta, Georgia for obodo America on Saturday 18 November, 2023.
Dis State Farm Arena big well-well, im capacity reach 16,000, and dey available to take host any kain event. Even NBA team, Atlanta Hawks dey use am as dem homeground.
Plenti artists go follow Davido perform for ‘A.W.A.Y Festival’ and dem be Mayorkun, Victony, Lojay, Spinall, King Promise (Ghana), Musa Keys (South Africa), witi other musicians.
Di ‘Unavailable’ crooner announce say: “ATLANTA ! DAVIDO PRESENTS: THE FIRST ANNUAL A.W.A.Y FEST ! @StateFarmArena see ya there !!!”