Charly Boy, oga kpatakpata wey dey run OUR MUMU DON DO ORGANISATION, tuk say, Presido Ali Bongo for Gabon go “rot in jail” after e “impoverished the people of Gabon”.
![]() |
Ousted President of Gabon, Ali Bongo Ondimba. Photo: TP advisers on behalf of the President’s Office/AP Photo/picture alliance via DW |
Coup plotters for inside Gabon don use force comot Presido Ali Bongo for di plenti “wickedness” wey e show di people for inside obodo Gabon.
As e dey now, Ali Bongo dey “his asking his fellow foreign thieves to come rescue him”, as Area Fada tuk.
Oga Charly Boy tuk join say, “African Leaders may dis happen to you too if you neglect ur people.”
Charly Boy tuk say: “See dis one.
Dis na President Ali Bongo of Gabon.
He impoverished the people Gabon, now his asking his fellow foreign thieves to come rescue him.
For all the wickedness you showed ur people, may you rot in jail.
African Leaders may dis happen to you too if you neglect ur people.”