Omo! E be like say Pep Guardiola go carry treble this season, cos as e be, nah only Inter remain o.
![]() |
Manchester City players take foto witi FA Cup trophy after dem beat Manchester United for final for inside Wembley 2-1 on Saturday 3 June, 2023 |
Make una no forget say dis Manchester City knack Ogbonge La Liga club, Real Madrid, four-zero for inside Uefa Champions League semi final second leg wey dem play for Etihad Stadium wey dey for obodo England.
Manchester City wey dem nickname, Citizens, don already carry Premier League 2022/23 – dats one trophy!
Dem beat Manchester United jus yesterday wey be Saturday 3 June, 2023 for FA Cup 2022/23 final for inside Wembley 2-1 – e don be two trophies nah!!
Like play-like play dem go carry treble dis season com make history join, buh dat one go happen if dem go fit beat Inter for Uefa Champions League 2022/23 final wey dem go play for Atatürk Olympic Stadium for Istanbul inside obodo Turkey on Saturday 10 June, 2023.
See as Manchester City players pose witi FA Cup trophy after dem beat their neighbor, Man United 2-1 for final.
Di foto dey alrite shaa.
Make I no lie, I happy for dem cos person gats celebrate with person wey dey celebrate so wen your turn reach dem go follow you celebrate – na so life be!
Buh, shay una tink say Guardiola go fit carry treble dis season?
Abeg, make we see as Citizens dey celebrate FA Cup win for dis foto ⬇
Foto: I dey hala @ManCity