Conversation ⬇ One X user don come out hail Naija Afrobeats singer wey be David Adedeji Adeleke OON, im stage name nah, Davido, cos of di ‘First A.W.A.Y Festival’ wey go shele for November.
![]() |
Naija Afrobeats singer, David Adedeji Adeleke, im stage name nah Davido. Photo: Getty Images via BBC |
Davido music concert wey e tag ‘A.W.A.Y Festival’ go shele for State Farm Arena wey dey for Atlanta for inside obodo America.
Di ‘Feel’ crooner announce say ‘A.W.A.Y Festival’ go shele for Saturday 18 November, 2023.
As di X user tuk, e say, State Farm Arena don remain small make e full o, come tuk join say for oyibo “almost sold out”.
Di X user tuk say: “State Farm Atlanta, GA Arena is almost packed and sold out.
“Davido is too big.”
Na im Davido come quote di X user tweet, buh e no tuk anytin, jus drop smile emoji witi flag of America.
Omo, dis one make sense o…
Abeg make we see di conversation ⬇
Abeg Read: Davido don announce ‘A.W.A.Y Festival’