‘Rotimi Amaechi no lie, Nigeria no dey fear God’ – Charly Boy

‘Rotimi Amaechi no lie, Nigeria no dey fear God’ – Charly Boy

Oga kpatakpata wey dey run Our Mumu Don Do Organization, wey be Charly Boy, don come out tuk say e gree witi wetin Governor for Rivers State before-before tuk, say, wey Naija need to do make “change” for come.

Area Fada tuk say e no be Amaechi supporter buh wetin the former Minister wey serve for under Buhari gonment tuk, say, “e no lie”.

Oga Charly tuk say, as Naija be right now, “e no dey fear God’, no dey fear sense and e no dey fear consequences”.

As Charly Boy take yarn on top X: “You see ehn…When Amaechi say, “Revolution must be bl*ody for change to happen,” e no lie. Forget say him na part of dem dem.

“The truth be say, The system we dey fight? E no respond to grammar. E no dey hear peaceful protest. You carry placard, dem carry b*llet. You cry for justice, dem ask you to go to court.

“So maybe, just dey yarn bcos him time don pass. Because this Nigeria no dey fear God, no dey fear sense… e no dey fear consequences.

“Look around you, has anything really changed without people losing something?

“#EndSARS , they k*lled our brothers. Fuel subsidy protest, they used g*ns. Charlyboy dem teargass am him pass out. Even the ballot, dem rig am with vi*lence. Dem draw bl*od.

“So if revolution go happen for real, If we really wan take back our land…E go cost something. I no fit lie to you, bl*od must flow. Even in our fear, we must face whats facing us.

“Nigeria no fit change with cruise. It won’t heal with vibes. It will take fire. And fire burns.

“Because dem no dey beg evil to pack and go. You confront it. You drag it. You shake the table till it breaks.

“But hear me well

“Let the bl*od that speaks be sacrifice, not senseless death. Let it be commitment, not chaos.

“Revolution is not just about b*llets. It’s about unshakable resolve. About saying NO and meaning it. About facing fear and still moving forward.

“So if you’re not ready to lose something, Forget this talk of a better Nigeria.”

Share:

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *