Naija ogbonge Afrobeat singer wey be David Adedeji Adeleke OON, buh im stage name nah Davido, dey bless God cos say e dey alive, and e dey Kampe as he enter 32 years old today wey be Thursday 21 November, 2024.
![]() |
Davido. Photo: @davido |
Davido write say: “Omo God is good!! My eye don see shege!!”
Dem born Davido for 21 November, 1992 for Atlanta, Georgia for inside obodo United States (US).
Di ‘Unavailable’ singer tuk say: “big 32 soon!!! Omo God is good happy to alive!! My eye don see shege!! Buh steady my fans dey shout shekpe!!!”