‘Football ehn fit give person BP’ – Nah Davido tuk am

‘Football ehn fit give person BP’ – Nah Davido tuk am

Naija ogbonge Afrobeats singer wey be David Adedeji Adeleke, OON, AKA, Davido, tuk say, “Football ehn fit give person BP.”

Dis im tuk dey come as Inter and Barcelona play 4-3 for di Uefa Champions League semi final second leg wey dem knack for Tuesday night for inside San Siro for Milan.

Dat match ehn, nah person wey get mind suppose watch am cos the thrill plenti.

Davido tuk say: “Football ehn fit give person BP … I remember when CR7 personally invite me come watch match for Old trafford then couple years ago … He don book dinner ALL! Party chillin etc …. Nah so dem go lose match .. BABA VEX GO HOUSE .. since that day I still never forgive Maguire.”

Inter go follow any team wey win for PSG and Arsenal when dem play for Wednesday 7 May, 2025, play for final wey go shele for Allianz Arena, Munich, Germany.

'Football ehn fit give person BP' - Davido
Share:

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *