Dis nah convo wey shele between France Presido, wey be Emmanuel Macron, and Naija Presido, wey be Bola Tinubu.
![]() |
Emmanuel Macron welcome Presido Bola Tinubu for im kontiri, France. Foto: State House |
Macron tuk say “Na big honor for France to welcome President Tinubu”, den Tinubu come reply say, “Na big privilege to dey strengthen dis bond wey join Nigeria and France together. My padi!”.
As Presido Macron take tuk am: “Na big honor for France, dear President Bola Tinubu @officialABAT, to welcome you for dis State visit as one big partner and friend of today and tomorrow.
E still dey sweet me well well as I remember say I be young intern for French Embassy for Nigeria that time.”
Presido Tinubu come respond: “Merci beaucoup, President Macron
@EmmanuelMacron. Na big privilege to dey strengthen dis bond wey join Nigeria and France together. E sweet me well well to hear say di memories of your time as young intern for Nigeria still dey inspire you. E show say di connection between our two countries strong and go continue dey strong.
We must to continue dey build dis our partnership wey stand for mutual respect and equality, wey go help di dreams of our people today and create better future for tomorrow. Thanks for di warm welcome and fruitful meetings, my padi!”
Abeg, make we see as the Convo between Macron and Tinubu take shele:
Merci beaucoup, President Macron @EmmanuelMacron. Na big privilege to dey strengthen dis bond wey join Nigeria and France together. E sweet me well well to hear say di memories of your time as young intern for Nigeria still dey inspire you. E show say di connection between our… https://t.co/zrUUS1IPSS
— Bola Ahmed Tinubu (@officialABAT) November 28, 2024