AFCON 2024 Qualification: Nigeria 1-2 Rwanda – ‘Abeg make Una no taya to support us o’ – Nah Super Eagles tuk am

Super Eagles of Naija don come out dey beg Naija pipu say, “we no say Una dey vex”, come tuk say, “abeg, make Una no taya to support us o”.

Super Eagles of Naija
Super Eagles of Naija. Foto: @NGSuperEagles

Super Eagles dey tuk dis one after dem lose 1-2 for inside Godswill Akpabio Stadium for di Africa Cup Of Nations (AFCON) 2025 qualifier wey dem play against Rwanda for Monday 18 November, 2024.

Naija pipu dey vex say nah Super Eagles first score, buh dem slack, come allow Rwanda wey their nickname nah Wasps score two (2) goals for inside three (3) minutes.

E no too bad as e be say Naija don collect ticket for AFCON 2025 wey go shele for obodo Morocco, and Rwanda wey even beat Super Eagles no see ticket.

Na im be say nah Naija and Benin dey go Morocco from Group D; Rwanda and Libya go sit down for house.

Super Eagles tuk say: “Our pipu we no say Una dey vex, we understand. Make Una no look us less less, we no go fall Una hand. We go work hard to continue where we for stop for the last Afcon. Abeg make Una no taya to support us o. We thank Una, Una too much. When I say, Super, You say Eagles. #SoarSuperEagles “

HC: Di win pain cos say dem come from back win Naija for our own turf again! Haba!!

AFCON 2024 Qualification: Nigeria 1-2 Rwanda - 'Abeg make Una no taya to support us o' - Nah Super Eagles tuk am
AFCON 2024 Qualification: Nigeria 1-2 Rwanda - 'Abeg make Una no taya to support us o' - Nah Super Eagles tuk am

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *