Paris 2024: ‘E don set’ – Super Falcons go face Brazil for Olympic

For di Olympic wey dey come wey dem tag ‘Paris 2024’, Naija Super Falcons go face Brazil for Group C.

Super Eagles of Nigeria prior to kick off of second leg Olympic Paris 2024 qualifier against Bayana Bayana of South Africa in Pretoria, South Africa on Tuesday 9 April, 2024
Naija Super Falcons. Photo: @GiftMonday21

Super Falcons qualify for the tournament after dem beat South Africa 1-0 for aggregate after two legs.

For di first leg wey dem play for Abuja, Nigeria, Super Falcons beat Bayana Bayana 1-0 as Rasheedat Ajibade score from penalty spot; and for Pretoria, South Africa, Naija go dere follow dem hosts play 0-0.

Witi dis result, Naija don qualify for Paris 2024 and dem don draw Super Falcons for inside Group C where dem go play Spain, Japan and Brazil.

Super Falcons write for X say: “E don set.


“@Paris2024, we are coming!


“Watch out.”

HC: No shaking Super Falcons! We go soar high for Paris 2024!

Super Eagles of Nigeria prior to kick off of second leg Olympic Paris 2024 qualifier against Bayana Bayana of South Africa in Pretoria, South Africa on Tuesday 9 April, 2024
Super Eagles of Nigeria prior to kick off of second leg Olympic Paris 2024 qualifier against Bayana Bayana of South Africa in Pretoria, South Africa on Tuesday 9 April, 2024

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *