Naija Afrobeats singer, Yemi Eberechi Alade, AKA, Yemi Alade, don tuk say, she no want make anybody carry “badluck go dey do handshake before our Eagles play o”.
Super Eagles go play Ivory Coast for di final for 2023 CAF Africa Cup Of Nations (AFCON) for Sunday 11 February, 2024 for inside Alassane Ouattara Stadium wey dey for Abidjan.
Presido Tinubu don direct Vice Presido, Kashim Shettima, make e lead Presidential delegation go Ivory Coast go support Super Eagles.
Yemi Alade tuk say: “Make some people no carry their badluck go dey do handshake before our eagles play o .”
HC: No shaking! Super Eagles go carry AFCON trophy come back! Buh who be di “some people” wey Yemi Alade dey tuk for here?