As Naija don reach final for di AFCON 2023 wey dey shele for inside obodo, Ivory Coast, after dem beat South Africa 4-2 for penalty, Madam Aisha Yesufu dom come out tuk say, e go better “make we dey use football sense during election”.
![]() |
Naija players dey celebrate as dem reach final for AFCON 2023. Photo: @NGSuperEagles |
Naija go play Ivory Coast for final for Sunday 11 February, 2024; Ivory Coast wey dem nickname nah ‘Elephants’ beat DR Congo wey be ‘Leopards’ 1-0 for semi final wey dem play for Wednesday 7 February, 2024, nah same day wey Naija beat South Africa.
After Naija match, Aisha Yesufu com tuk say: “Imagine instead of fielding Stanley Nwabali we decided to field a goalkeeper from the 80s because it is his turn.
“Make we Dey use football sense during election.
“Religious and tribal sentiments don’t give you positive results.”
HC: Me no dey gbadun all dis kain tuk. I go like make we jus celebrate Super Eagles! e no make sense!!