Foto ⬇ Our Naija women basketball team don go carry cup for basketball tournament wey dem play for obodo Rwanda for inside Africa.
![]() |
D’Tigress player pose witi FIBA Women’s Afrobasket trophy after dem beat Senegal 84-74 for di final for di tournament for inside obodo Rwanda |
As we dey call dem, D’Tigress, beat Senegal for final 84-74 for di FIBA Women’s Afrobasket 2023 win di title, dis hapun on Sunday 6 August, 2023.
Before D’Tigress reach final, come beat Senegal, dem don play other teams wey be Democratic Republic of Congo, Egypt, Mozambique witi Rwanda.
D’Tigress enter dem official Twitter page write say, “una good morning o! Trophy don show!!”
Omo, I salute our D’Tigress, e no easy at all!!
Make we see oda foto ⬇
Foto: I dey hala @DtigressNG