White Nigerian don pay ‘Sallah homage’ give Presido Buhari

I neva really gada enuff informate about di man wey dem dey call Mohammed Jammal, person fit call am ‘White Nigerian’ join.

Mohammed Jammal 'White Nigerian' don pay "Sallah homage" give Presido Buhari
Mohammed Jammal ‘White Nigerian’ don pay “Sallah homage” give Presido Buhari

White Nigerian get plenti people wey dey follow am for social media, even people wey get maut for inside Naija dey follow am too.

I don yarn una as White Nigerian take gist us im testimoni wey ‘Almighty’ carry give am.

Di testimoni nah about im pikin wey no dey alrite wen dem born am for di year wey jus pass, buh White Nigerian com pray say make im son dey well com follow am jolli for dis year’s Eid, and ‘Almighty’ give am im wish.

So, White Nigerian don com out drop foto say im jus go pay “Sallah homage” give Presido Buhari.

Even, Vice Presido wey dem dey call Yemi Osinbajo show for inside di foto.

Jammal tuk for oyibo say: “I paid Sallah homage to Mr. President”.

Abeg, make una see the foto ⬇️

Foto: I dey hala @whitenigerian

White Nigerian’s testimony about his son 👉 Here

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *