Tinubu don show for Naija and e dey ‘hale and hearty’ – nah ‘Wanderer’ tuk am

E get one man wey call himself ‘Wanderer’, e com out tuk say, our Naija Presido-elect, wey dem dey call, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu, don show for kontiri.

'Wanderer' witi Presido-elect, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu
‘Wanderer’ witi Presido-elect, Asiwaju Bola Ahmed Tinubu

‘Wanderer’ wey im name nah ‘Abdulaziz Abdulaziz’ com tuk join, say, Tinubu dey kampe and e ready to do di “big task” wey dey for am as Presido-elect wey e be.

Oga ‘Wanderer’ com drop one foto wey e snap witi Tinubu, tuk for oyibo say: “He’s home. Hale, hearty and ready for the big task.”

E don tey small wen Tinubu travel comot for Naija afta e win our Naija Presido election for 2023 wey dem do for Saturday 25 February.

As Tinubu enta Kontiri, na so plenti people, witi all those oga dem wey get maut for inside we kontiri, all of dem com out welcome Presido-elect witi im wife wey dem dey call, Senator Oluremi Tinubu, for Abuja.

Abeg, make we see the foto wey ‘Wanderer’ snap witi Tinubu for Abuja ⬇️

Foto: I dey hala @Abdulfagge

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *