Nah our Naija beta sharpshooter be dis wey dem dey call, Victor Osimhen.
![]() |
Naija ogbonge striker wey dem dey call Victor Osimhen |
Osimhen nah ogbonge futubola wey dey play for SSC Napoli for inside obodo Italy.
As e dey so, na im be di numba one striker wey don score goal pass for the League for Italy wey dem dey call Serie A.
Our Naija Super Eagles striker don score 21 goal for im club, Napoli, and all dis goal nah for inside dis season e score all of dem.
For dis foto, Osimhen no wear Super Eagles abi Napoli jersey. E jus wear simple polo, jean wey dem tear small for front witi sneakers. E jus dey alrite shaa!
Abeg, make we see our Naija striker Osimhen ⬇️
Foto: I dey hala @victorosimhen9