Make una see our ‘fearless’ Super Falcons defender Onome Ebi

Onome Ebi nah our madam for Super Falcons dem squad.

Our "fearless" madam for Super Falcons of Naija, Onome Ebi
Our “fearless” madam for Super Falcons of Naija, Onome Ebi

Nah she be captain for our Super Falcons, she go carry other players go show for Naija for di FIFA Women’s World Cup 2023 wey dem go host for inside Australia witi New Zealand.

Onome Ebi strong kakaraka for our Naija defence, and I sabi say una neva forget say our Super Falcons nack double friendly for obodo Turkey, witi Haiti wey dem win 2-1.

Dem com go nack witi New Zealand, still win tiri kongba and nah Onome Ebi score di numba one goal.

E neva tey wen dem beat New Zealand, na im she com out tuk say she be “fearless” wuman.

Buh me I tink say, she no only dey “fearless”, she fine well well join.

Infat, make I yarn una anoda gist, Onome Ebi dey play for FC Levante Las Planas for Obodo Spain – e shock una abi?

Abeg, make una see our madam for Super Falcons Onome Ebi ⬇️

Foto: I dey hala @EBIONOME

Comments

No comments yet. Why don’t you start the discussion?

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *