For una wey no sabi, Real Madrid oga for coach wey dem dey call, Carlo Ancelotti, nah footballer before before.
![]() |
Hmm…make una see Real Madrid oga for coach Carlo Ancelotti dey show skill for inside the game wey dem nack with Chelsea for Santiago Bernabeu for inside obodo Spain |
As e play im football finish na so e come arrange imsef enta coach level.
Omo, for dis foto, make una see di kain skill wey Ancelotti drop o, as im boiz wey dem nickname ‘Los Blancos’ dey hama Chelsea for inside Santiago Bernabeu.
For di Uefa Champions League match wey Real Madrid wit Chelsea nack for Wednesday night – Chelsea wey dem nickname ‘Blues’ chop better tu-ziro for obodo Spain.
Nah only God go fit send helep for Chelsea for dem second match wey dem go nack wit Real Madrid for Stamford Bridge inside obodo England cos say Madrid dey hot like fire for dis season.
Upon say e wear coret suit plus shoe o – infat, e still dey im body.
Abeg, make una see oga coach for Madrid Ancelotti as e take ball dey play play ⬇️
Una wey love Real Madrid plus ogbonge fans, abeg make una hala Ancelotti
Foto: I dey hala @realmadriden